King Charles: New royal cypher and im meaning don dey revealed

Publish date: 2024-08-27

27 September 2022

Di cypher for King Charles III don comot. Dis na di image wey dem go use by goment departments for state documents and post boxes.

Na di design wey di King pick by imself from range of designs wey di College of Arms produce come.

Di monogram combine im initial wey be C for Charles with R for Rex wey be di Latin word for king plus di III as in di third King Charles.

Di cypher wey di visual identity for im reign dey replace di E II R wey bin dey for Queen Elizabeth II reign.

Oda tins wey don change since King Charles III take di throne of England include:

But for November, plan dey to release four memorial stamps wey go show portraits of Queen Elizabeth II for different stages of her reign.

Dem use di new King Charles cypher for di first time afta di period of royal mourning bin finish.

Dis personal monogram for di new King bin dey used for di first time on Tuesday for Buckingham palace post room wen dem use to frank letters from di Royal Households.

Na image wey go get more use widely from uniform to office stationary to public buildings.

Dem go be anoda version of di cypher wey go dey used for Scotland. Dat one go get di Scottish Crown iside.

But no be now-now dem go change post boxes oh.

Even sef post boxes dey wey still dey in use from di reign of Queen Victoria, Edward VII, George V and VI and those mornachs cyphers go dey dia until dem need replace di boxes.

Almost 70,000 of post boxes wey dey now na from di reign of Queen Elizabeth II. Dem be like 170 boxes from di short reign of Edward VIII wey comot by imself for 1936.

Di Royal Mail say, boxes wey currently dey under construction go still get di late Queen cypher.

For buildings wey fo carry royal cyphers, e dey up to di organisation to decide weda dem go update dia cypher.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJommmvqqC%2BcsKUbJ6o